#MEDschoolREALITIES

Now clinical posting

I don’t know of your school but in my own school
After you’ve written First MB
They give small holiday then you will do Intro to path and pharm , junior clinical posting before advancing to path and pharm proper

Keep reading 😂
Na from that clinical posting problems go first surface from

Because after First MB wey you get like 3 pass for anatomy, physiology and biochemistry
Or maybe 1 credit 2 pass

You go turn your medical career to new year resolution
For your mind you go tell yourself say in this Class

“I must brace up in this path and pharm”

“Omo, I gats face my book squarely , no distraction “

“I must not fail any test/exam”
Wayray, no be say I wan make you fail
But omo medical school no care about your new resolution oo

They go drop clinical timetable
One half of the class for medicine

Another half will go for surgery
E go dey shark you like mad because they go tell you make you buy things wey go make you be like Proper Doctor like Ward coat, sthethoscope, patella hammer etc

Some people Dey buy sphygmomanometer 😭😭

Asper Wetin you don face for basic medical sciences, you wan turn new Leaf
They go release the time table, share the class into medicine half and surgery half.

Make I start with those medicine people first

Medicine is divided into clinic posting into different units like cardiology, dermatology etc and then classes proper
First Day of clinic posting na ,everybody go kit up
New reformed Doctors in town
Doctor of Anatomy and physiology😭😭😂😂

People go don snap picture like mad

E go be like merriment till
You reach your unit for clinic
Na where you go face real life
Make we use cardiology unit as example

You go first start with ward rounds Omo and one thing about medicine na say
attendance is important ‼️

Mehn imagine going round wards to see like 30 patients and they go Dey explain each cases as you Dey go round with consultant 😭😭
Mehnn perosn go stand like maddd 😭

E get some days you go stand from like 9am till like 3pm and if your consultant get time , una fit Dey there till 4/5 o clock

Hunger for don wipe your head like maddd

Because most likely you no chop comot hostel in the morning
Na smart people dey use style chook rite/bigi sausage for ward coat pocket and we go dey codedly chop am for ward round😂😂

As we Dey go round ,Consultant go Kon Dey percuss us with questions

person wey Na still upper and lower limb full on head with touch of
Cell membrane in physiology na in they go ask

10 causes of finger clubbing
Or
Causes of infective endocarditis

You sef instead you Dey quiet as you no know am; you fit just misyarn one purulent stuff😭😭😂😂

Consultant go Mud you with better abuse..una fit relate na😂
after Clinical posting of that day we go for the class session remember I said posting is divided into classes and clinical posting

They go Dey give slides like madd..you fit get 4 topics between 2pm and 4pm

Lectures go include teach how to clerk patient Nasomat, Nasarom etc
You go Dey feel like Doctor untop ordinary biodata😂

Some smart people for don go watch YouTube video on now to do Body examinations etc

You go still Dey struggle with history of presenting complaints😭😭😭😭
life no balance
As you Dey reach hostel after the whole day
you fit just Dey see your guys for surgery half Dey play ball or Dey flex
They go tell you say
“surgery is chilling na“

Well life na turn by turn
The medicine Sapa go still go round reach una turn😭😭😭😂
Next day na clinic day, this time around
Patient that came for consultations will be around

If una get luck, they fit pair 600 level students so you go fit learn more about clerking

Because after clerking you are expected to present the case/patient to the consultant
But if luck no Dey on tbat first day , na you and few of your classmates go clerk the patient

Now As you wan clerk , all this clerking depend on your approach and the kind perosn wey the patient be

If they go give you person wey no Dey calm down,the clerking fit hard for you
Lemme give Case scenario of problem wey Patient wey no cooperate fit cause

You go wan form humble doctor
After introduction
You go ask for his/her name
The person go tell you
You go Dey follow NASAROM format
Till you reach like marital status
You- Ma are you Married or Single
( person wey don tire for Your question maybe she fight with her husband that morning )
She go nonchalantly tell you
“ he is just there”

Out of the whole non chalancy of patient
Maybe na
“He was just dead” you hear
You go do your remaining clerking

You go look around, some people don reach stage of measuring blood pressure , You wey still Dey bother with history taking

Time go reach to present to Consultant

Wayray instead make you double check your history
You no do am😭😂😂😂
You go reach front of consultant

I’m here to present Mrs xxx ggg, a 45 year old widow...na where trouble go start for you.
woman wey Dey nonchalant before go Dey active

She fit just first shout -I reject it in Jesus name,
Woman- Shey na you kill my husband
Na where you go know say, life no be two

Consultant go wan end your life with insults

You go wan defend say “ she said her husband just died”
The woman go talk” Liar, I said my husband is just there “

Wahaleaux.. another round of insults
This kinda scenario where you prolly clerked rubbish and consultant will finish you happens In different ways to people and different people handle it differently

Some days you go wan cry with regrets for studying the medicine because aside the insults, stress too😓
Or After consultant don Dey you say

“ e no sure if your vision and future align with medicine , say make you just drop out go learn one trade “

Ahhhh..A whole me wey get 1 credit , 2 pass in first Mb, 5A for waec, 4.8CGPA😭😭😭

😂😂😂😂😂😂😂
Well with time you go Dey used to the stress and all, you for don sabi clerk sha,till day of exam because in the exam
You go do theory , Mcq and clinicals

Na clinical mad pass, Walahi out of fear of failure, you fit Dey beg the patient make e cooperate with you say na Exam
But las las you go still pass or you fit
Fail too make I no lie

If you pass theory and mcq and you fail clinical
You don fail the exam be that

But if you pass clinical well and you fail theory and mcq, cumulatively you fit still pass the exam 😂

Surgery people coming next 😂
You can follow @theakorede.
Tip: mention @twtextapp on a Twitter thread with the keyword “unroll” to get a link to it.

Latest Threads Unrolled:

By continuing to use the site, you are consenting to the use of cookies as explained in our Cookie Policy to improve your experience.