After so much anticipation to visit the @FilmhouseCinema Osogbo and my love for Funke Akindele, I decided to kill two bird with one stone, i.e visit the film house and watch Omo ghetto.

Na the story be this

So my brother con visit me and decide to flex me around osogbo.
I sharply clear am, Baba with the little change wey dey our hand, e b like say na Osun mall we go enter ooo. E say no problem.
I took my bath and decide to put on one fine Jersey (though na fake), I rock am with my new slide from @king_riyike000 store.
Omo, me sef look mirror 😘😘, I peng. Drip lomo.
We decide to visit @BeautyPsaloon for nice cut before showing up at the mall, I need to look good nah, I'm tired of this single pringle stuff, I might meet the rib of my rib at the cinema, our love go just be season film.
As we reach Cinema, Omo the place fine no be small, so na here all those fine jpeg wey people dey upload for status dey come from, Oga oooo. I sha go order for ticket and the hanty is attending to me nicely, she tell me the film will be in 30min time, no wahala, we gada dey.
I was about leaving her when she say, uncle you will not buy guguru ni? Immediately I remembered @tosinlarewaju, guguru 1k, haa, Mio lowo ooo. Won Gbemi wa bi bayi ni. The hanty say it's not compulsory, even if it's I no go still buy, mo lagidi gan.
30min to movie, ah, we cannot sit down ooo, let us take some jpegs jhur. My brother was sha snapping me upandan, emi fine boy, won ma gba. It was all fun ooo until @joesteve__ babes show, awon hanty mainland.
This hantys were just snapping upandan, *in my mind* I was like mummies, this picture is too mush nah, if you wan do photoshoot, I fit give you @wacwhiz number, oluya ni boy yen, e can snap anything. This sisters did not mind ooo, they were just snapping like òde.
Me I was sha doing low-key, which of this aunties will I follow talk now, @SirBosun no teach this babe how to package oo. Woo, let us go and buy 100 naira popcorn inside justrite jare.

As we enter justrite, the first thing my brother said was, " why is this place small nah"
I say it will be big later, we just dey develop am small small. The yeye boy talk say even Edinwo store for Tanke big pass this one, problem tie niyen. We sha buy plenty popcorn and went back to enter the cinema theatre.
We went back to film house and was about entering when one fine hanty blow me grammar say I can't go in with my popcorn 🍿. What do you mean, is it by force to buy from you? hanty sha say nooo, I can't go in. I cooperate sha, drop my popcorns and drinks with them.
Before entering, some mainland bigboys show, drip everywhere, Omo, this one will snatch all the babes for here, set awon boyfriend @oluwajobabiola leleyi ooo. iPhone 13, iPhone 12 pro Tab, bling bling every where, kòkòrò Benz leleyi mùdàni ooo. Anyways, you can't oppres mi.
Me sef get redmi 7 and iPhone6s plus, even though the screen don blank, na the same apple we get. But egbon you're driving Benz and your undies dey dirty, iwa òbun niyen.
Anyways, we enter cinema and the setting was cool, I love it, I'm not new to cinemas so I know it's nice.
As we were entering the cinema like this, one hanty wey dey my back just say, "walai TV wòn yi Tobi ooo" I wanted to laugh but her boyfriend is huge, e will just kill me.
We sha sit down enjoying the movie, one of the ice on ma neck bros was just spoiling every scene.
Ok, egbon you don watch am before but dey don't make noise at the cinema, abi èru awon mainland people wo leleyi. Joe, your people no try ooo.
Another hanty was even disturbing us with some unwanted gist, her voice is not even sexy, she just dey talk anyhow.
it was not long into the movie, one pikin just start crying, ewò re, is this sound coming from the movie or from the cinema hall, koyemi mo ooo. Anty sha give d baby bwess, everywhere calm.
The movie is sweet and I'm enjoying it, @FunkeAd finish work for the film.
1 hour into the movie, some bastard begin to kiss 😘 their self behind me, ah ah, yes, you love each other but don't oppress me nah, can't you see I'm single, this Una love bird thing fit make me depress ooo. Small small nah, boda no even bother, I'm just hearing muah, muah.
Small time one security enter, ehen, arrest them, they are disturbing me but e be like say e no see dem, the security guy just waka pass. Isokay, oppression no go kill me, I'm sure of that.

We sha finish movie and I stand up dey comot, one hanty just run come meet me...
This hanty fine no be small, I was like kilode hanty, no be me carry you come oooo. Hanty was like high bee calm down, we follow each other on twitter.
Haaaa awon temi🙌🙌🙌🙌, we sha exchange number and hanty hug me, she was just smiling to me and me sef dey smile.
Thank you God ooo, na one stone I take kill Tiri bird, it won't end in tears. Say amen nah abi you're enemy of progress ni?.
@InsideOsogbo no go see me for fine place now ooo.

Film house cinema is a nice and cool place.. looking forward to visit again.
You can follow @badmusib.
Tip: mention @twtextapp on a Twitter thread with the keyword “unroll” to get a link to it.

Latest Threads Unrolled:

By continuing to use the site, you are consenting to the use of cookies as explained in our Cookie Policy to improve your experience.