I no be type wey dey read book 
ThePantTooManyManyToPackOoo no go school but em be millionare.. U get to d point now baa 




My mama send me to school but wetin just full my head na Toto and inshallah 
.. Na to drop out dey hungry me.. No be my fault.. I look up to Dremo 




One very good Saturday morning, na wen my cup full.. (Hanty Ada em no go better 4 you and dat your big brezz wey u use confuse me) 
.. Thank you 4 turning me to trash.. The God of Laycon will trash you for me 




That Saturday, during extra curricular learning, I was on my own reading my book..(This lie self no go well,
.. Make I no lie you, I bin dey write love letter give Amaka.. That girl body bang
)


As I still dey write love letter, one voice tell me say make I look up.. I look up, lo and behold, Aunty Ada, of the blessed memorial (YES !! OF THE BLESSED MEMORIAL !! COZ U GO DIE VERY SOON AUNTY !! 
)


As I look, Aunty Ada of the blessed memorial (
) bin dey face the class dey talk the nonsense wey full her mouth dey call am teaching. Omooo Ă infinity. Her button open and her bress big pass her bra, so em dey push out. Aunty, ya now fully talking in the rubbish. Thank you 



Na so Adam tap me.. "Gee how far. You dey see wetin I dey see" ?? Oohh, you mean the phosphate VI tetracycline bitrogenous gas Aunty is mixing in front of the class ?? Yess, I see it 
Werey


Aunty Ada come look me.. Werey me.. My eye no gree commot her bress.. I dey try but na mission impossible and Tom Cruise no dey around 2 help me..
She come trace my eye to her bress.. Come ask me wetin I dey look.. Adam, dem no ask u naaa 
.. Adam just shout "Aunty, he's steering at ya bress".. Steering kor, handbrake nii..


The response alone vex my body eehh.. I no even sabi wen my hand do reflex action punch am for nose.. Adam flare up.. "You punch me guy.. You punch me.. You will hear from my lawyer"
Ya a bastard.. Your lawyer will hear from my native doctor.. Idiot
Ya a bastard.. Your lawyer will hear from my native doctor.. Idiot


Na so Hanty Ada carry me go principal office. Dem come ask me why I punch my fellow student. I'm just celebrating ma.
Celebrating what ??
Ma, I'm celebrating boxing day..
Diz boy needs to be rusticated
Celebrating what ??
Ma, I'm celebrating boxing day..
Diz boy needs to be rusticated


Boxing day is the day you unbox the gifts you got on Christmas. Not going upandan punching people.
Aagghh.. Ma, they don't use to do diz 1 in my side o. We always do wrestling competitions 2day o
Aagghh.. Ma, they don't use to do diz 1 in my side o. We always do wrestling competitions 2day o
Ma, I bin dey think say the boy na ajekpako.. I no sabi say na agege bread em be.. Em no even sabi block.. Just 1 small blow, em hormones pour out red oil..
Na so them rusticate me.. Adam I have no grudge against you 
.. Em get 1 picture wey u snap.. D tin go well.. My baba wan help u frame am.. U get to the point now ?? Noo ?? No worry, u go get there later 












Abeg make una follow me, like and comment.. Em no easy for me again.. If I do boxing day again, make buhari die 
.. My mama wan drive me commot house.. Abeg @fadererah_ @ObongRoviel @SMiTHiE___ @AsiwajuLerry


Help me 

